Singa Fire: Nigeria goment, APC governors don donate N8 billion to victims
Vice President Kashim Shettima announce di donation when im go di market on Monday for sympathy visit.
Di Nigeria goment don approve di release of N5 billion on Monday to help di victims of di Kano Singer Market fire disaster.
Not only dat, di All Progressives Governors Forum, wey Imo State Governor Hope Uzodimma dey lead, also promise N3 billion for di victims.
Vice President Kashim Shettima announce di donation when im go di market on Monday for sympathy visit.
While im dey yarn for Kano, Shettima tok say dis help na to make di victims fit start dia business again and make market activity comot from ground zero.
"Your Excellency, we join you today no be only to show say we sorry about di fire outbreak for Singer Market wey don scatter di commercial life of dis great state, but we come carry di promise of Federal Goment say we dey stand with di good pipo of Kano."
"President Bola Tinubu don approve di release of N5 billion to Kano State Goment as palliative for dis incident."
"And di Progressive Governors Forum, wey Governor Hope Uzodimma dey lead, don also promise N3 billion to support di victims of di fire incident for Singer Market."
"Together, we don contribute N8 billion to di victims of di fire disaster."
"Di Federal Government dey with you for dis moment of wahala and go continue to give di support wey necessary," Shettima yarn.
Di visit happun after di fire wey start on Saturday evening, February 14, 2026, for di Gidan Glass section of di market along Ado Bayero Road and burn well-well reach Sunday morning.
Di fire affect more dan 1,000 shops and dem dey yarn say seven traders dey missing.