Di African Union don tok say di attack and killing wey happun for Zamfara State no good at all. Dem send condolences to di family wey dem lost dem pipo, and pray make di wounded pipo quick well.
Di Chairman of African Union Commission, Mahmoud Ali Youssouf, constrongly talk say di attack wey terrorist pipo do on February 21, 2026 for di state, na bad bad tin. For im statement, im tok say di attack kill more dan 50 civilians and dem also carry women and pikin go.
African Union tok say dem no gree for any terrorist attack or bad tin wey pipo go do against civilians, especially women and pikin. Dem say dis kain tin na serious abuse of human rights and e dey spoil peace and security.
Youssouf tok say African Union dey with Nigeria Gment and di pipo for dis matter, and dem dey feel sorry for di family wey dem lost dem piple. Im tok again say di whole Africa dey support Nigeria to make sure insecurity stop and peace better come back.
Di Chairman call on di pipo wey carry di women and pikin make dem release dem quick quick without any wahala. Im also tok say make di authority take strong action to protect civilians, so dat dis kain attack no go happun again, according to wetin African Union dey do to make sure peace and security dey for whole Africa.
WORLD
2 minit wey yu go read
African Union condemn di killing wey happun for Zamfara, Nigeria
Youssouf tok say African Union dey with Nigeria Goment and di pipo for dis matter, and dem dey feel sorry for di family wey dem lose pipo.
Explore











