Nigeria open borders with Benin, Niger Republic wey dey Kebbi state
As Customs Area Comptroller for Kebbi State, Mahmud Matawalle Ibrahim dey open di borders, e yarn say President approve say make legitimate goods fit pass
Nigeria Customs for Kebbi State don open Kamba and Tsamiya borders for Dandi and Bagudo local government areas make Benin and Niger Republic pipo fit trade.
Dem bin close dis borders before because of insecurity wey dey happen around di area. But now, after Nigeria and Benin Republic talk and agree, dem don open am back.
As Customs Area Comptroller for Kebbi State, Mahmud Matawalle Ibrahim dey open di borders on Monday, im talk say na President approve am make legitimate goods fit pass from Tsamiya border go Niger Republic through Kamba border for Kebbi State.
Im tok say because of dis opening, many trucks wey bin dey stuck from Benin Republic don officially clear for Tsamiya, to enter Niger Republic side for Tunga Jado through Kamba border.
Im com add say make di borders open go make trade between di kontris better, e go even help security since all of dem don promise to follow di agreement and make business for border run well.