Authorities dey investigate wetin lead to death of author Chimamanda pikin
Di government talk say di probe go examine whether di hospital follow standard operating procedures, conduct of dia health professionals and patient safety rules.
Lagos State government don order investigation over allegation say medical negligence cause di death of Nkanu Nnamdi, 21-month-old, son of famous writer Chimamanda Ngozi Adichie, for one private hospital for di state.
Di pikin, wey be one of Adichie twins, reports say die after short illness.
Lagos government talk say dem don officially notice di statement wey Adichie release about di matter, wey she describe as very disturbing and sad.
For statement wey Dr Kemi Ogunyemi, the Governor's Special Adviser on Health sign, Lagos government commiserate with di family and emphasise say di pikin death na big, heart-breaking tragedy.
Di state government still confirm say dem no go tolerate any form of medical negligence or lack of competence for any health facility for Lagos State.
Dem talk say Governor Babajide Sanwo-Olu don instruct di Health Facility Monitoring and Accreditation Agency (HEFAMAA) to begin full independent investigation sharp-sharp and in open manner into how di pikin die.
According to the statement, HEFAMAA don already visit di hospital where di thing happen and don start full review of all di allegations and reports wey concern di case.
Di investigation go also involve di Medical and Dental Council of Nigeria and other relevant agencies.
Government talk say di probe go examine whether hospital follow standard operating procedures, di conduct of the health professionals, patient safety rules, and di role wey each party play.