Lagos and Benue dey lead as Nigeria report 20,838 new HIV cases
Lagos get di highest number of cases — 2,298 — follow by Benue wit 1,949. Akwa Ibom come third wit 1,159 cases, den Rivers wit 1,137 and Anambra wit 1,013.
Nigeria don report 20,838 new HIV infections from January to March 2026, with Lagos and Benue states show di highest numbers, according to di National Data Repository.
At di same time, religious leaders and pipo wey dey live wit HIV/AIDS for di country don yarn say e important to strengthen and join HIV services inside primary healthcare, and make sure everybody fit get new tins like long-acting injection wey fit prevent HIV.
Lagos get di highest number of cases — 2,298 — follow by Benue wit 1,949. Akwa Ibom come third wit 1,159 cases, den Rivers wit 1,137 and Anambra wit 1,013.
For north, Kaduna get 842 cases, while Kano get 476. Oda states wey get numbers include Delta (803), Oyo (763), Ogun (751), Plateau (662), Imo (640) and Nasarawa (615).
Di Federal Capital Territory (FCT) get 579 cases, while Abia and Edo get 527 and 512 cases respectively. Ebonyi get 253 cases, Gombe 252 and Borno 238. Ekiti get 129 cases, Sokoto 110 and Yobe get di smallest number, 100.
Di Nigerian Government don tok say dem go pay $346 million as co-financing for 2026 to help fight HIV, tuberculosis and malaria. Di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Prof. Muhammad Pate, tok dis one during di national rollout of Lenacapavir, wey be long-acting injection for HIV prevention.
“For dis major bilateral funder situation, di co-financing for 2026 be almost $346 million extra. Di President don already tell di Budget Office of di Federation to make sure say dem put am inside 2026 budget,” Pate tok.
He note say di money go support important areas like medical supplies, lab surveillance, reagents, primary healthcare expansion and financial protection for citizens.