Nigeria goment vow to handle insecurity for Zamfara as governor join ruling APC

Vice President Kashim Shettima make di promise on Tuesday for Gusau while e dey formally receive di governor into APC.

By
Nigeria VP Kashim Shettima / Reuters

Nigerian goment don tok say dem go do everything to solve di security wahala for Zamfara State as Governor Dauda Lawal officially cross to All Progressives Congress.
Vice President Kashim Shettima make di promise on Tuesday for Gusau while e dey formally receive di governor into APC.

Shettima say di Federal Government go send enough security personnel and equipment to fight banditry wey don dey threaten lives and property for di state.
E congratulate Lawal for joining di ruling party and assure am say Federal Government go support and cooperate with am to push development for di state.

Di Vice President also urge Zamfara residents to support President Bola Ahmed Tinubu and Governor Lawal for 2027 general elections to make dem win again.
E tok, “Di federal government go do every humanly thing possible to remove di bandits wey don dey terrorize di people of dis state”.

“We go give di necessary assistance and support to Governor Dauda Lawal to continue di good work wey e don start”.
“I dey call on di good people of dis state to re-elect President Bola Ahmed Tinubu and Governor Dauda Lawal for di 2027 general elections.”

For im own talk, di Minister of State for Defence, Bello Matawalle, announce say e no go contest Zamfara governorship election for 2027, and e declare say e dey support Lawal to win second term.