| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Petrol consumption for Nigeria don hit record low as price no dey help mata
Reports say di rising price of petrol don make plenty Nigerians abandon dia vehicles or stop to use petrol-fueled generators.
Petrol consumption for Nigeria don hit record low as price no dey help mata
Petrol price don go up wella

Nigerians consume di lowest amount of petrol in August as price of di product dey skyrocket.


Analysis of di factsheets wey Nigerian Midstream release show say di average consumption of 41.6 million litres of petrol wey dem consume in August na 31 percent reduction from di 60.2 million litres wey dem consume in January.

Even though analysis show say consumption dey waver from month to month as no consistency dey for di drop, di rising price of petrol don make plenty Nigerians abandon dia vehicles or stop to use petrol-fueled generators.

Even though di price increase na di US-Iran war wey scatter fuel supply trigger am, most Nigerians don accuse di federal government say e dey expose Nigerians to bear di brunt of di war while oda countries don introduce some kind of subsidy to protect dia citizens.

Nigerians consume di lowest amount of petrol in August as price of di product dey skyrocket.


Analysis of di factsheets wey Nigerian Midstream release show say di average consumption of 41.6 million litres of petrol wey dem consume in August na 31 percent reduction from di 60.2 million litres wey dem consume in January.

Even though analysis show say consumption dey waver from month to month as no consistency dey for di drop, report say di rising price of petrol don make plenty Nigerians abandon dia vehicles or stop to use petrol-fueled generators.

Even though di price increase na di US-Iran war wey scatter fuel supply trigger am, most Nigerians don accuse di federal government say e dey expose Nigerians to bear di brunt of di war while oda countries don introduce some kind of subsidy to protect dia citizens.

A breakdown of di eight months average consumption show say consumption high pass in January with a daily average of 60.2 million litres wey dem consume. Dis one fit be because of di yuletide festivities.


Consumption drop to a daily average of 56.9 million in February and e go down to 47.3 million in March.


E however increase to 51.1 million in April and further drop to 46.3 million in May. Consumption go back up to 47.4 million in June and e maintain di increase to 48.3 million in July before e drop to 41.6 million in August.