Di opposition party, African Democratic Congress (ADC) don call on Nigeria federal government make dem introduce "temporary and time-bound cap" for petrol price, so dat e no go rise again and make life harder for Nigerians.
For statement wey dem release on Wednesday, Bolaji Abdullahi, wey be ADC spokesman, talk say di recent increase for petrol price show say global oil market dey very unstable.
"Di African Democratic Congress (ADC) dey beg Federal Government make dem quick-quick introduce temporary and time-bound cap for petrol price, so dat e no go continue to rise and make cost of living too high for millions of Nigerians wey dey suffer," Abdullahi yarn.
"Di recent hike for petrol price show say global oil market dey very unstable, partly because of di crisis wey dey happen for Middle East."
But e still talk say ADC believe say external wahala no be excuse to allow fuel price to just dey go up anyhow "for economy wey already dey struggle, and wey still dey feel di effect of Tinubu-led APC government wey abruptly remove fuel subsidy."
President Bola Tinubu first announce say fuel subsidy don end on May 29, 2023, during im inauguration, but Nigeria finally stop di under-recovery payment when dem deregulate di downstream sector for October 2024.
POLITICS
2 minit wey yu go read
ADC dey beg Nigerian goment to put temporary price cap for petrol as Iran war dey hot
For statement wey dem release on Wednesday, Bolaji Abdullahi, wey be ADC spokesman, talk say di recent increase for petrol price show say wahala dey.
Explore










