President Bola Tinubu tell EFCC make dem go court go get order to remove freeze for Osun State government accounts.
President talk say e shame am well well for di timing of wetin EFCC do, especially as di state go hold governor election for few days time.
Di President give dis directive afta di mata wey EFCC action cause, as dem freeze di state accounts few days before Osun governor election.
E still call Governor Ademola Adeleke of Osun State, and tell am wetin e tell EFCC make dem go vacate di court order wey freeze di state account.
Meanwhile, afta President Tinubu tell EFCC make dem unfreeze Osun State account, di state government thank President for di big intervention, and say na victory for rule of law.
For anoda mata, Governor Adeleke yesterday carry N2 billion case go court against EFCC, over wetin e call di unlawful freezing of di state Federal Statutory Allocation Account.
E ask di court make dem give am N2 billion against di defendants, as “punishment and extra damages for di unlawful way dem interfere with public funds,” and make dem also order di defendants to pay di court case money.
For dia side, Osun State Government reject EFCC claim say dem freeze dia bank accounts becos of “alleged diversion of N11 billion ecological and intervention funds,” and dey insist say di commission action na political game.
POLITICS
2 minit wey yu go read
Tinubu ask EFCC to get court order wey go make dem unfreeze Osun goment account
President talk say e shame am well well for di timing of wetin EFCC do, especially as di state go hold governor election.

Explore

























