| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Nigeria tell Chinese phone makers to consider making dia phones for inside di kontri
Di government talk say tax waivers and oda special operating incentives go dey available for any phone manufacturing company wey take up di challenge, before November dis year.
Nigeria tell Chinese phone makers to consider making dia phones for inside di kontri
President Bola Tinubu of Nigeria / AP

Nigeria authorities dey find way to make dem produce mobile phones for inside Nigeria.

Dem don tell Chinese phone makers and dia Nigerian counterparts make dem consider to set up phone manufacturing factories for Nigeria, and for exchange, government go give dem sweet business incentives wey go make am sweet for dem.

Di government talk say tax waivers and oda special operating incentives go dey available for any phone manufacturing company wey take up di challenge, before November dis year.

Di Chairman of Nigerian Communications Commission, NCC’s board of commissioners, Dr. Idris Olorunnimbe, throw di bait for di Digital Africa Summit Roundtable wey hold for Shanghai, China.

Olorunnimbe, when dem call am to share Nigeria’s side concerning smartphone affordability as di way to enter digital world, e go straight to di matter wey dey pain Nigeria: “I want to start from where every honest conversation about affordability suppose to start, with di gap between wetin we don build and wetin our people fit actually afford.

Nigeria na di biggest mobile market for di whole continent. We get more than 170 million mobile connections, and over 150 million Nigerians dey use mobile internet now, wey be say nearly two out of three of our citizens.

“Di networks dey there. Di coverage dey there and we dey increase coverage everyday. But still, according to GSMA dia own surveys, di biggest single problem wey dey keep Nigerians offline no be coverage, and e no be di price of data. E be di price of di device wey dey dia hand. Dat na di problem wey I come here to talk about.

“Dis work dey inside clear national direction. Nigeria President don put di digital economy for di center of im Renewed Hope agenda, e dey treat connectivity as productive infrastructure for di whole economy, not as luxury for only few people,” e talk.