| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigeria dey push for peace with South Africa over anti-foreigner protest
As part of di move, di Nigerian High Commission for Pretoria present three cows to di Rharhabe Kingdom according to Xhosa tradition.
Nigeria dey push for peace with South Africa over anti-foreigner protest
Nigeria dey try cool tins down afta all di wahala wey happun / Reuters

Di Nigerian government don beef up diplomatic efforts to cool tension for South Africa afta di wahala wey surround di alleged coronation of one Igbo traditional ruler, as fresh anti-foreigner protest suppose hold today (Monday).

As part of di move, di Nigerian High Commission for Pretoria present three cows to di Rharhabe Kingdom according to Xhosa tradition, as dem describe am as gesture to appease di community and make di relationship strong.

Di President of di Association of Yorubas in Diaspora, South Africa, Olusola Agbeniyi, na im yarn dis one.

According to am, di intervention na to settle di tension wey di mata cause and make sure say cordial relationship between Nigeria and South Africa continue, while dem still dey protect Nigerians wey dey live for di kontri no matter where dem come from.

E add say di diplomatic step don help reduce di tension, as di Consulate General for Johannesburg don release advisory dey beg Nigerians make dem dey law-abiding and behave like good ambassadors.

"Di presentation of di cows and di continuous engagement don reduce di tension well well. We dey appeal to our pipo make dem stay calm and stay far from flashpoints, because protests dey expected on Monday, wey be Freedom Day. Dem talk say na peaceful anti-foreigner protest," Agbeniyi yarn.

Freedom Day na annual celebration wey dem dey do on 27 April for South Africa.