Anxiety for Nigerian football fans as FIFA wan decide World Cup petition
If dem win the case, Super Eagles fit still come enter di six-team Intercontinental Play-off wey dey happen next month.
Millions of Nigerian pipo wey love football dey shake for body dey wait to hear wetin FIFA go talk today about di petition wey Nigeria Football Federation (NFF) carry put against Democratic Republic of Congo (DRC) for di matter of player wey dem no suppose use for match.
You go recall say for Morocco last November, Nigeria bin lose 3-4 for penalty shootout to DRC, di tin wey scatter dia hope to go 2026 FIFA World Cup wey America, Canada, and Mexico go host.
But on December 15, 2025, NFF carry dia complaint go FIFA, dey claim say six Congo players wey just change dia international allegiance no suppose play for dat important match.
FIFA don dey look di mata, and dem say dem go announce dia final word today, Monday, February 16, 2026.
If FIFA talk say NFF right, e go change evritin for Nigeria World Cup campaign. Di Super Eagles fit still come enter di six-team Intercontinental Play-off wey dey happen next month, wia dem dey fight for World Cup ticket.
NFF General Secretary, Dr Mohammed Sanusi, don talk before say dem sure of dia case, say dem no dey do wahala for notin. "We get strong case," na im im talk. "As we dey see am, we get strong case, and we dey wait FIFA decision for di complaint wey we carry put."