| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
UN oga say Africa deserve permanent seat for Security Council
Guterres describe Africa Union as a "flagship for multilateralism" for dis world wey dey full of division and mistrust.
UN oga say Africa deserve permanent seat for Security Council
Antonio Guterres / Reuters
17 Februwari 2026

Di UN Secretary General, António Guterres, don tok say di way dem no give Africa permanent seat for di UN Security Council, na bad tin wey no make sense.

While im dey yarn for di 39th African Union (AU) Summit wey hold for Addis Ababa, di UN boss tok say di way UN and AU dey work together don reach "new heights" for di past ten years. Im point to di joint arrangement wey dem get for peace and security, sustainable development, and human rights mata.

"Dis na 2026, no bi 1946," im yarn. "Any time dem dey make decision wey concern Africa and di whole world, Africa must dey present for where dem dey take decision." Guterres describe AU as a "flagship for multilateralism" for dis world wey full division and mistrust.

Im yarn three main tins wey dem need to work on well-well: Peace, economic action, and climate justice. Di UN Chief call for make dem stop di fighting for Sudan sharp sharp, make dem start dialogue again for South Sudan, and make dem respect di land of Democratic Republic of Congo. For di Sahel, Libya, and di Horn of Africa mata, im stress say di solution must come from di African pipo demselves, but di world must dey behind dem with support.