As Middle East don hot well well because America and Israel dey fight Iran, di acting Inspector General of Police for Nigeria Olatunji Disu, don tell all police commands make dem put eye for ground so dat di internal security wey we get for country no go worse pass where e dey.
Di IGP don especially tell police commissioners for Northwest, Northeast, and Northcentral zones make dem increase dia surveillance and intel gathering, work well well with traditional rulers and religious leaders, put more police for places of worship and public areas, and make sure any person or group wey wan use dis global matter cause trouble or incite one religion against di other, dem go quick quick handle am.
Di IGP message come out for statement wey di Force Public Relations Officer (FPRO), Benjamin Hundeyin, wey be acting Assistant Commissioner of Police (ACP), release for Abuja yesterday. For di statement, Disu tell Nigerians make dem no worry, say police go do dia best to protect people and property and make sure peace remain for di country.
"Even though Nigeria dey peaceful and di internal security dey under control, di police don already increase dia proactive and intel-led policing for di whole country," di statement tok.
"Di acting IGP don order all police commissioners for di 36 states and Federal Capital Territory (FCT), especially for Northwest, Northeast, and Northcentral zones, make dem increase dia surveillance and intel gathering, work well well with traditional rulers and religious leaders, put more police for places of worship and public areas, and quick quick handle any person or group wey wan use dis global matter cause trouble or incite one religion against di other."
WORLD
2 minit wey yu go read
Middle East wahala: Nigeria police oga put commands for red alert
Di IGP don especially tell police commissioners for Northwest, Northeast, and Northcentral zones make dem increase dia surveillance.

Explore






