Nigerian government and Labour Union bin clash yesterday over how dem take use di money wey dem save from removing fuel subsidy.
Government explain say dem use di savings to pay for Ways and Means, service foreign debt, increase federal workers salary, give students loan, and oda tins. But labour say dem no gree, accuse government say dem dey "economical with di truth" and demand verifiable evidence to back up di claim.
Di Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Mr. Taiwo Oyedele, yarn dis one for di ongoing 7th Africa Emerging Markets Forum for Abuja. Im promise say for di coming days, im go give Nigerians details of how dem use di savings.
Im talk say: "Somebody ask about di subsidy savings, where e go?
"I don hear dis question plenty times, and guess wetin? E be valid question. Di combined effect of subsidy on fuel, and wetin I like to call subsidy on FX, na about five percent of GDP, so if you remove both, you save money.
"But saving money no be di main goal, na to remove di distortion and corruption for di system wey be more important. But di money saving still dey important.
"So, where di money go? And for few days, you go see detailed analysis because we believe say we get duty to explain wetin we dey do to Nigerian people. Dat na wetin transparency mean. But for now, I fit give una some highlights," im talk.
But di Nigeria Civil Service Union (NCSU), di Joint National Public Service Negotiating Council (JNPSNC Trade Union Side), and one senior official from Nigeria Labour Congress (NLC) challenge Mr. Oyedele to give full account of di subsidy savings and explain how dem use am.
Di General Secretary of NCSU and National Secretary of JNPSNC (Trade Union Side), Olowoyo Gbenga, throway di minister claims, say na result of wetin im call unprecedented poor budget implementation for public service.
According to am, di Federal Government dey implement 2024, 2025, and 2026 budgets at di same time, wey im say don spoil fiscal policy and lead to explanations wey no make sense.
Im question di minister claims say dem use fuel subsidy removal savings to service debt and pay workers salary increase, and im ask "wetin happen to di personnel costs wey dem already provide for inside 2024, 2025, and 2026 budgets wey dem dey implement at di same time?"
POLITICS
3 minit wey yu go read
Nigerian government and Labour Union clash over fuel subsidy money
Government explain say dem use di savings to pay for Ways and Means, service foreign debt, increase federal workers salary but Labour no gree.

Explore






















