| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
NAPTIP don receive 105 Nigerians wey dem rescue from Ghana cybercrime criminals
Ghanaian government talk say dem rescue 119 Nigerians during di operation, and out of dat number, dem repatriate 105, while dem still dey process di remaining 14.
NAPTIP don receive 105 Nigerians wey dem rescue from Ghana cybercrime criminals
Ghana still dey process di remaining 14

Di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) talk say e don receive 105 Nigerians wey dem rescue for one coordinated operation against cybercrime syndicates for Ghana.


One statement wey di agency Head of Press and Public Relations Unit, Mr Vincent Adekoye, issue on Monday, talk say di rescue operation follow President Bola Tinubu citizen-focused policies.


Adekoye talk say di Office of di National Security Adviser (ONSA) coordinate di operation after di Cyber Security Authority of Ghana contact NAPTIP.

He talk say NAPTIP lead di Nigerian Security and Law Enforcement agencies wey participate, including di Nigeria Immigration Service (NIS), di National Commission for Refugees, Migrants and Internally Displaced Persons (NCFRMI).


Others na di Department of State Services (DSS), di National Intelligence Agency (NIA), di Nigerian High Commission for Ghana, and di Federal Airports Authority of Nigeria.
He talk say different stakeholders hail di development, including Civil Society Organisations and international organisations wey dey collaborate.


Adekoye talk say di development show di commitment of di Federal Government of Nigeria to di safety of Nigerians, especially victims of human trafficking and irregular migration.

He quote di Ghanaian government talk say dem rescue 119 Nigerians during di operation, and out of dat number, dem repatriate 105, while dem still dey process di remaining 14.