INEC don fix new date for Nigeria presidential election
Di national commissioner and chairman of information and voter education committee Mohammed Haruna announce dis new timetable for inside statement on Thursday.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) for Nigeria don announce say January 16, 2027, na di new date for presidential and national assembly election. Dem also fix February 6, 2027 for governorship and state assembly election.
Mohammed Haruna, wey be national commissioner and chairman of information and voter education committee, announce dis new timetable for inside statement on Thursday.
Before now, di electoral body don schedule February 20, 2027 for presidential and national assembly election, and March 6, 2027 for governorship and state assembly election. But dem coman change am because dem cancel di old Electoral Act of 2022 and bring new one, Electoral Act of 2026.
Haruna yarn say di new Electoral Act of 2026 bring some changes to di time wey dey waka for pre-election and election mata. E add say di commission check wetin dey happen and adjust di earlier timetable make e waka well-well with di new law.
"Based on dis one, di Commission don decide say: Presidential and National Assembly Elections go happen on Saturday, 16th January 2027. Governorship and State Houses of Assembly Elections go happen on Saturday, 6th February 2027," di statement tok.