Di US Embassy for Nigeria don tok say dem get information say some bad pipo dey plan to attack US places and schools wey get link with America for di kontri.
For di warning wey dem put for dia website, di embassy say di alert na to make sure say all Americans for Nigeria know about dis danger, and dem advise dem to dey very careful whenever dem dey go US Embassy or any American schools.
Di statement tell US citizens to open eye well well when dem dey travel to dia offices for Abuja and Lagos, and also to schools wey get connection with United States.
"Di US Embassy for Abuja dey tell US citizens about possible terror attack against US places and schools wey get link with US for Nigeria."
"Di Embassy dey advise US citizens to take extra care when dem dey go US Embassy, US Consulate for Lagos, and schools wey get US link, like make dem dey change di time and road wey dem take dey go," di statement tok.
Di embassy also tell Americans make dem no dey follow di same pattern of movement, and make sure dia phone dey charged well well just in case anything bad happen.
WORLD
2 minit wey yu go read
US dey warn dia pipo for Nigeria about fresh terror threat
Di statement tell US citizens to open eye well well when dem dey travel to dia offices for Abuja and Lagos, and also to schools wey get connection with United States.
Explore













