Imported fuel and diesel don dey reach Nigeria as price still dey hot
According to Nigerian Ports Authority Shipping Position wey dem release one vessel wey carry 20,000 metric tonnes of petrol, don reach Lagos Ports .
As Nigerians dey struggle with high petrol price, ships wey carry 129,000 metric tonnes of Premium Motor Spirit (petrol) and Automotive Gas Oil (diesel) go soon reach Lagos Ports between March 14 and 17, 2026.
Dis news come as officials of Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) explain why some importers still dey bring in petrol, even though di agency tok say dem no issue any petrol import licence dis year.
According to Nigerian Ports Authority (NPA) Shipping Position wey dem release on Monday, one vessel wey dem call Mosunmola, wey carry 20,000 metric tonnes of petrol, don reach Lagos Ports for Bulk Oil Plant on Sunday, March 14, 2026. Anoda vessel, Kobe, wey get 22,000 metric tonnes of diesel, dock for Kirikiri Lighter Terminal Phase 2, for Tin Can Island Port, di same day.
For Tuesday, March 17, Bora go arrive Kirikiri Lighter Terminal 3B with 27,000 metric tonnes of petrol, while Ashabi go bring 30,000 metric tonnes of diesel to di same terminal.
Not only dat, Oluwajuwonlo don offload 15,000 metric tonnes of petrol for Calabar Ports through Ecomarine Nigeria Limited on Sunday, March 15. Anoda ship, Mosunmola, go still deliver 15,000 metric tonnes of petrol to Calabar Ports through North West Petroleum Gas Co Limited terminal on March 17.
Dis ships dey come as fuel price still dey rise across di whole country. Nigerians dey face hot price for petrol after Dangote Petroleum Refinery increase dia gantry price to N1,175 per litre, wey make retail price pass N1,200 per litre for some places. Dis price increase don affect transport fare and make price of goods and services high for di whole nation.