Nigeria Air Force order probe afta dia plane reportedly kill two farmers
At least two farmers reportedly die, while e no clear how many oda pipo, including pikin dem, carry injury for di airforce aerial attack.
Nigeria Air Force (NAF) don order for investigation into reports wey talk say civilians die for air operation wey dem carry out on January 25 for Kurigi Village, Kontokoro District, Mariga Local Government Area of Niger State.
At least two farmers reportedly die, while e no clear how many oda pipo, including pikin dem, carry injury for di aerial attack wey happen for di community.
Residents tell TRT Pidgin say helicopter dey fly around di area for some minutes on Sunday before e start to dey shoot pipo wey just dey do dia daily work.
According to one resident, di gunshots enter residents for inside dia house compound, and pikin dem dey among di pipo wey dem shoot.
One local man, Suleiman Sanusi, say di incident don make fear increase for di community, and e don force plenty residents to run comot from dia house go Bangi town and oda safe places.
Sanusi describe di attack as shocking and say nothing provoke am. E call on di authorities wey dey concern to quickly investigate di matter and give medical help to di injured pipo.
Air Commodore Ehimen Ejodame, wey be NAF Director of Public Relations and Information, talk for statement on Wednesday say di investigation go be by Civilian Harm Accident and Investigation (CHAI) team to know wetin exactly happen for di reported incident.