| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
US troops wey dey come Nigeria no go fight, na for only training – military tok
Dis one come after US official tok on Tuesday say Pentagon don plan to send di troops go train Nigerian soldiers wey dey fight Islamist militants,
US troops wey dey come Nigeria no go fight, na for only training – military tok
FILE PHOTO: A U.S. Army soldier dey train Nigerian Army soldiers for military compound wey dey Jaji, Nigeria / Reuters
12 Februwari 2026

Nigeria military tok on Wednesday say di about 200 US troops wey go soon arrive for di coming weeks no go carry gun fight, and Nigerian forces go still dey in charge of all security decisions.

Dis one come after US official tok on Tuesday say Pentagon don plan to send di troops go train Nigerian soldiers wey dey fight Islamist militants, weeks after President Donald Trump give order against wetin im call Islamic State targets.

Last week, US military confirm say dem don send small team go Nigeria, but dem no give details. Dis one be di first time Washington dey admit say dem get personnel for ground since di Christmas Day attacks.

Major General Samaila Uba, wey be spokesperson for Nigeria Defence Headquarters, tell Reuters say Abuja ask US make dem come give technical training and advisory work for different places.

"Dis people no be combat soldiers, dem no go carry gun for any operation," Uba tok. "Nigerian forces still dey in charge of all command authority, we dey make all operational decisions and we go lead all missions for Nigeria land."

Im no gree tok di exact time di troops go arrive, but im say di deployment na part of di cooperation wey dey go on under di US-Nigeria Joint Working Group.