‘Di conviction of terrorists for Nigeria go give hope to victims’
US hail Nigeria over 386 terrorism convictions for dia own side, di United States commend di kontri for securing 386 convictions for terrorism-related cases.
Di United States of Amerixa, civil society organizations (CSOs), and one senior lawyer don hail di conviction and sentencing of Boko Haram terrorists to life imprisonment by Federal High Court for Abuja.
Dem describe di landmark judgment wey Justice James Omotosho give as one step wey dey correct.
For dia own side, di United States commend di federal government for securing 386 convictions for terrorism-related cases, and dem describe di development as big step towards justice and accountability.
U.S. Senior Advisor for Arab and African Affairs, Massad Boulosin, for one statement wey im share for X yesterday, talk say: “Di United States dey commend di Nigerian government for dia strong commitment to speed up trials wey dey address terrorism and related crimes.
“We welcome di convictions of 386 Islamist militants for cases wey don suffer serious delay for court before, and we see dis as important step towards accountability and justice.”
Di U.S. still stress say transparent legal processes dey important to fight extremism, as dem talk: “we believe say timely and transparent legal processes dey very important to confront extremism and strengthen public trust for judicial institutions.
‘’To follow di rule of law remain essential to ensure di safety, stability, and long-term security of all Nigerians.”
Di Executive Director of Global Rights Nigeria, Abiodun Baiyewu, talk say di judgment go give more confidence for di nation’s justice system.