Nigeria music legend 2Baba say na Burna boy be global Afrobeats king
One podcast host ask 2Baba to choose one artist from di "big three" wey be Wizkid, Burna Boy, and Davido.
Nigeria music veteran 2Baba don finally drop im own opinion for di debate about who be di current king of Afrobeats, and e say Burna Boy na di man wey dey on top.
Dem ask am di question for inside one podcast wey dem dey call Mic on Podcast with Seun Okinbaloye. Di host ask am to choose one artist from di "big three" wey be Wizkid, Burna Boy, and Davido.
2Baba (wey im real name be Innocent Idibia) talk say e like all di three artists well-well, but im answer clear for who dey lead di game for now.
"Each of dem get songs wey I like pass, but as e be right now, I think say na Burna dey on top of di game," di music legend yarn.
E tok say im choice na just wetin e see from how di music world dey move, e no mean say e know who get more money or better success for business.
"Ehn, I no know wetin dey dem bank account, I no get any secret information about dia personal success, so I no fit talk about dat side," 2Baba explain. "But from wetin I know, from common sense and di way I understand di music world, I think say for now, Burna dey on top. No be just for Nigeria or Africa alone, but for di whole world."