Nigerian goment launch plan to helep adults wey no fit read or write
Di initiative go first start for Federal Capital Territory and di areas around am, and dem plan to reach 300,000 youths and adults.
Di National Commission for Mass Literacy, Adult and Non-Formal Education (NMEC) for Nigeria don launch one initiative wey go help adults wey no fit read and write, and also give youths and adults skills wey dem fit use for life.
Di programme, wey dem call Staff-Led Literacy Facilitation Initiative (NSLFI), go make NMEC workers go set up and run literacy centres for communities wey get plenty people wey need education.
Di initiative go first start for Federal Capital Territory and di areas around am, and dem plan to reach 300,000 youths and adults.
Staff wey volunteer go serve as teachers for community centres, markets, work places, and religious gatherings.
As dem dey launch di programme for Abuja, di Executive Secretary of NMEC, Prof. Garba Maitasfir, wey Dr John Edeh (Director of Education and Development) represent, tok say:
“As we don see for recent months, with di big target to reach 300,000 youths and adults with functional literacy skills, di time to dey do things di usual way don pass. Illiteracy still dey hold back national progress, economic inclusion, and social equity.”
Prof. Maitasfir explain di main parts of di initiative, e tok: “Di strategies include advocacy and sensitization of community leaders, women and youth; finding and setting up literacy and vocational centres; providing teaching and learning materials; and training staff on how to teach adults, with focus on digital skills.”
Di programme mix basic literacy with functional skills, including digital literacy, financial literacy, health education, and vocational training. Di aim na to make literacy become something wey people fit use for practical purposes, for lifelong learning and national development.