| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
1 minit wey yu go read
Nigeria dey target 60 gas plants wey go boost production
Dis one dey inside di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Gas Master Plan for 2026 wey newspaper report.
Nigeria dey target 60 gas plants wey go boost production
Nigeria wan begin dey use dia gas well. / Reuters
2 Februwari 2026

Nigeria plans to use gas to power di kontrii and do oda big industrial tins don dey serious. Dem don line up 60 big gas project wey dem want to finish for di next ten years.

Dis one dey inside di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Gas Master Plan for 2026 wey some newspaper see on Sunday.

Di plan show say 30 of di project go finish for di first 3 years. Di oda 30 go finish for di next ten years.

All di project join go make plenti gas come out — about 13,960 million standard cubic feet everyday. Dis gas go go for inside industries, for houses, and also for export

Na for Abuja dem first show dis new plan on 30th January, 2026. With dis plan, Nigeria no dey just talk about gas again, dem don begin work am seriously to make di kontri develop, get better light, and create more jobs.