Gunmen don kill nine Nigerian soldiers for Kebbi state attack
Two army sources and one resident talk say di soldiers dey patrol near dia base for Kebbi Shanga district when di gunmen attack dem late for Tuesday night.
According to security sources and local officials wey talk for Wednesday, gunmen don kill nine Nigerian soldiers and wound plenty oda people for di northwestern state of Kebbi.
Kebbi state, wey share border wit Benin and Niger, be among di northwestern states wey armed kidnapping gangs dey move almost anyhow, plus di Islamist militants wey dey increase dia presence for di region.
Two army sources and one resident talk say di soldiers dey patrol near dia base for Kebbi Shanga district when di gunmen attack dem late for Tuesday night.
Di army sources say dem suspect di Lakurawa militant group, wey dey operate for dat area and dey target Nigeria security agents.
Kebbi state governor Nasir Idris confam di attack afta he visit di wounded soldiers, but he no give di number of pipo wey die.
Insecurity be di biggest problem wey President Bola Tinubu government dey face, around three years afta e take office.
Di Nigerian army no talk anything yet.