Nigerian community for South Africa don warn say dem go protest to demand justice for one Nigerian wey dem call Emeka Uzor, wey dem report say police shoot am dead for inside one anti-drug operation for Gauteng, one area for Johannesburg.
Dem report say dem kill Uzor around 3pm for February 8, 2026, for Carltex garage wey dey Windsor East, Randburg for Johannesburg.
For one statement wey dem publish for dia website, ActionSA confirm say di shooting happen during dia anti-drug raid.
Di statement talk, "ActionSA fit confirm say during one anti-drug operation yesterday, wey our Ekurhuleni Mayoral Candidate, Cllr Xolani Khumalo join, one shooting happen wey one Nigerian suspect wey dem identify as drug trafficker, dem shoot am.
"For too long, drug gangs don dey terrorise our communities with violence, threat and no respect for law. ActionSA go continue to support any strong and legal action wey go stop dis wahala and face di violent criminals wey dey think say nobody fit touch dem. Dat time don pass and e must end."
Mrs Abike Dabiri wey dey handle mata wey concern Nigerians wey dey obodo yibo neva tok anything on top dis mata.










