| Pidgin
WORLD
1 minit wey yu go read
Pipo die for Nigeria after road accident for Lagos-Abeokuta road
After di crash happen, Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Agency (TRACE) warn market people make dem no display dem goods for walkway again.
Pipo die for Nigeria after road accident for Lagos-Abeokuta road
Accidents on raods na major issue for Nigeria / AP
2 hours ago

Three people don die for crash wey happen for Toll Gate area for Lagos–Abeokuta Expressway for Ogun State..

Six oda people collect injury for di accident wey involve one white Howo Sino truck with number T4995LA; one yellow commercial bus wey get mark SMK 199YK; another yellow commercial bus wey get number AGL 394YA; one LT commercial bus wey get number FKJ 360YH; one yellow Suzuki bus wey get mark AKD 98YL; and another yellow Suzuki bus wey get number KSF 23YA.

After di crash happen, Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Agency (TRACE) warn market people make dem no display dem goods for walkway and road side so dat dem go fit prevent accident wey dem for avoid.

TRACE spokesman Babatunde Akinbiyi talk say 15 people bin involve for di crash. Six victims — three men and three women — collect injury, while three other people — one small pikin wey be girl, one woman and one man — die.

E say di accident happen because brake fail for di Howo truck, and di driver no fit control di vehicle again, so e jam odas cars and crush passengers wey dey try board bus.