Nigerian banks don mature to compete for global level – Tinubu

Di President yarn dis matter during di opening of Zenith Bank UK Limited new branch for Manchester, United Kingdom.

By
A view dey show Nigeria Central Bank headquarters ifor Abuja / Reuters

President Bola Ahmed Tinubu don tok say Nigerian banks don grow well-well, make dem fit compete with international banks, and dem get strong foundation wey dey put dem for better position to dey carry both local and foreign capital.

Di President yarn dis matter during di opening of Zenith Bank UK Limited new branch for Manchester, United Kingdom. Dis one na subsidiary of Zenith Bank Plc.

Im yarn say di opening of dis new international branch for UK by Zenith Bank show how Nigerian banking sector don develop to become global institutions wey fit help grow international investment and trade. According to am, dis one dey follow as Nigeria dey increasingly get recognition as emerging economic force.

"Nigeria banking sector don mature well-well. Our banks don get better capital, dem don advance for technology, and dem dey look more for international market," Tinubu yarn.

Di President tok say dis kind international expansion wey Zenith Bank do by open Manchester branch dey align with Nigeria broader economic direction.

Wey dey represent am na Minister of State for Finance, Taiwo Oyedele. Tinubu yarn say im administration reforms dey aim to improve macroeconomic stability, make investment climate better, simplify tax system, and strengthen financial ecosystem.

"Di objective clear: To make Nigeria more competitive and attractive for people to bring dia capital. Financial institutions like Zenith Bank get important role to play for achieving dis one by dey connect capital with opportunity," Tinubu tok.

According to am, Zenith Bank expansion go Manchester no just show ambition, but e also show confidence say Nigeria financial institutions fit compete for global level. Dis kind expansion go put Nigerian banks for position to dey facilitate global capital, no be only local intermediary.