Boko Haram attack trucks wey dey carry food for Borno wey dey Nigeria

Another eyewitness talk say di terrorists shoot di vehicle tires before dem set am for fire.

By
Di armed group dey cause plenty wahala for Nigeria. / AA

Dem suspect say na Boko Haram or ISWAP terrorists intercept another set of trucks wey dey carry beans from Monnguno town, near Burmari village for Guzamala Local Government, go Maiduguri.

Just five days ago, di same terrorists don intercept one trailer and three dump trucks wey dey carry maize and building materials go Monguno and Mairari village for di same Guzamala area.

One of di truck drivers and some security sources tell reporters say di latest wahala happen on Saturday, around 9.30am, for di road between Burmari and Garin Kashim villages.

"We believe say na di same gangs wey burn di trucks five days ago. We just run meet di boys (terrorists) close to Burmari. I just comot from my motor run enter bush.

"For dis time, dem block two trailers and three of our dump trucks. Dem set di trailer head on fire, comot enter bush. Na beans we dey carry go Maiduguri when di insurgents strike us," di driver talk.

Another eyewitness talk say di terrorists shoot di vehicle tires before dem set am for fire. E add say, "We thank God say di drivers wey escape dis time around, gather people from di community come quench di fire before e reach di main body of di trailer."

Another driver complain say security operatives no dey stay for di dangerous portions of di road, no be like wetin dey happen for other volatile roads for di state.

"If you dey travel go Gwoza, you go see soldiers wey dey stationed for strategic place for road to prevent dis kain attack, but we no get such thing for dis our own road.

Many truck owners don comot dia vehicles from dis road now. Dis things dey happen always, and nothing don dey do about am so far," im yarn.