Tunji Disu: Tins to know about Nigeria new police oga
For im work life, Disu don handle plenty sensitive and important roles inside Nigeria Police Force, including leadership positions for Special Anti-Robbery Squad (SARS).
Di Assistant Inspector-General of Police (AIG) wey dey in charge of Force Criminal Investigation Department (CID) Annex, Lagos, Tunji Disu, don become Nigeria new Inspector-General of Police, but di appointment go need green light from Nigerian Senate first.
Before im new position, Disu don serve as Commissioner of Police for Federal Capital Territory and Rivers State, and later di former IGP, Kayode Egbetokun, send am go Abuja.
For im work life, e don handle plenty sensitive and important roles inside Nigeria Police Force, including leadership positions for Special Anti-Robbery Squad (SARS), anti-kidnapping units and state CID.
Check out five tins to know about dis new police boss:
1. E show say e care about pipo during EndSARS protests
For di 2020 EndSARS protests, Disu wey be di Commander of Lagos State Police Rapid Response Squad (RRS) show sef say im policing style put pipo first.
Under im watch, RRS ambulances dey give medical help to protesters wey wound. Di way e handle tins make police and civilians begin trust each other again, and residents dey give information without fear, because dem know say e go keep am secret.
Security experts later talk say di RRS under Disu be good example of professional policing wey care about community.
2. Im get hand for di arrest of notorious kidnapper Evans
Disu play big part for di operation wey catch di notorious kidnap kingpin Chukwudumeme Onwuamadi, wey dem dey call Evans.
Dem catch di suspect for im Magodo house for Lagos, and dat one become one of di biggest wins for Nigeria fight against organised kidnapping and violent crime.
3. E recover stolen iPhones from South Africa
For anoda big operation, Disu lead investigation after some pipo burgle one major iPhone store for South Africa.
Intelligence reports show say di stolen phones don reach Computer Village for Ikeja, Lagos. Im quick and sharp response make dem recover di phones and return dem, and South Africa authorities praise am well well.
Dis operation also help make dem give Lagos State award for 2016 by Security Watch Africa as one of Africa safest states, while RRS become di best anti-crime police unit for West Africa.
4. E deal with violent cultism for Rivers State
As Commissioner of Police for Rivers State, Disu lead serious operations against violent cult groups wey dey terrorise communities.
Under im command, security operatives kill notorious cult leader Gift Okpara, wey dem call "2Baba," di main suspect wey kill Divisional Police Officer Bako Angbashim for Ahoada East Local Government Area for 2023.
Di operation use both land and aerial surveillance, and e help bring some peace back to di area.
5. Im be champion judoka and decorated officer
Apart from police work, Disu be experienced judoka wey don compete for many years.
For di U.S. Open Judo Championship for 2022, e win silver medal, competing against more than 500 international athletes.
E start judo for 1986 and don win plenty medals, including two gold for National Sports Festival, plus honours for Nigerian Police and Armed Forces Games. For 2021, e also win gold for Nigerian Police Veterans Championship.