One member of Anthony Joshua family no like as dem dey prosecute driver
Di driver wey dem charge for di car crash wey injure Anthony Joshua and kill im friends, appear for one Nigerian court on Tuesday.
Di driver wey dem charge for di motor crash wey injure Anthony Joshua and kill im friends show for Nigerian court on Tuesday as di star boxer uncle dey wonder if di trial really worth am.
Adeniyi Mobolaji Kayode, 46, na im dey drive di former two-time heavyweight champion Joshua and two of im friends, Latif Ayodele and Sina Ghami, when dia Lexus SUV jam one parked truck.
Kayode face plenty reckless driving charges and e still get charge for driving without licence.
E wear black trouser and hoodie; Kayode look depressed and e try avoid camera dem of journalists outside courtroom for Sagamu, for di south-west part of di country.
E no too worth am
"We lucky say our pikin no die. But to carry this man go court na wetin we no see reason for," Joshua uncle, Adedamola Joshua, tell AFP for di boxer family house.
"Na my own personal opinion sey di trial no too worth am. Because we dey reason sey accident fit happen anywhere for this world."
At di same time, e add sey "we sense wetin people for di town dey talk" be sey "this man must face prosecution. Say e dey speed."
Traffic Compliance and Enforcement Agency (TRACE) for di Ogun state part of di highway wey di crash happen tell AFP after di December 29 incident sey preliminary investigation show sey di vehicle dey drive too fast and di tyre burst before di collision.
Case adjourned
Kayode court appearance for Tuesday short well as judge adjourn di case till February 25 after prosecution ask make dem delay.
Im lawyer, Olalekan Abiodun, tell journalists outside di courtroom sey e agree to di adjournment "for the interest of justice."
Nigerian police and state officials talk sey Ayodele and Ghami die for the scene while Joshua and Kayode get small injuries.
Ghami na Joshua long-time strength and conditioning coach, while Ayodele na im personal trainer, weh British media report.
Joshua driver for three years
Adedamola Joshua tell AFP sey Kayode don dey im nephew driver for three years and never get any complaint about am.
Im nephew, wey be British national wey get Nigerian roots, dey often visit south-west Nigeria where e get friends and family.