| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
At least 30 pipo die inside village attack for northern Nigeria
Dogon Rana, wey be secretary to di village head, say di gunmen storm di community, dey shoot anyhow and burn houses.
At least 30 pipo die inside village attack for northern Nigeria
Attacks like dis dey happun wella for Nigeria

At least 30 pipo lost their lives when armed men attack one village for northwest Nigeria Kaduna state early Monday morning, two residents tell newsmen.

Dogon Rana, wey be secretary to di village head, say di gunmen storm di community, dey shoot anyhow and burn houses.

Eight children dey among di dead, while four oda pipo get injuries.

Violence from armed gangs and oda criminal groups don become big security problem for many parts of northwest and north-central Nigeria, where communities dey regularly face deadly attacks.

Di northeast dey fight serious insurgency by Islamist militants Boko Haram and dia splinter group ISWAP. No group don claim responsibility for di Kaduna state attack.

Youth leader Ishaya Dawa, anoda resident, say di attackers storm Naridon village for Kauru local government area close to midnight and open fire on residents.

Dawa say some residents dem cut throat, and add say several bodies don carry go mortuary.

"Di victims na women, children and elderly pipo," Dawa tok. Di attackers set houses on fire before dem run comot, e tok.

Dawa say security personnel reach di village for morning, hours after di attack.

Kaduna State police spokesperson Mansur Hassan say di command go give details soon.