| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Nigeria don lose 62,400GWh of electricity sake of gas flaring inside two years
Dis loss dey happen as di world oil and gas industry dey change from flaring gas to instead to dey capture am and sell am for power generation.
Nigeria don lose 62,400GWh of electricity sake of gas flaring inside two years
Gas flaring

Nigeria lose 62,400GWh of electricity wey dem for generate from gas wey dem burn for flare between 2024 and 2025—even with di penalties wey Federal Government dey give and di efforts to stop di practice.

Dis one be 18.6 percent increase from di 50,800 GWh wey dem record for 2022 and 2023.

Dis loss dey happen as di world oil and gas industry don dey change from flaring gas to instead dey capture am and sell am for power generation, industrial use, and export.

Data wey dem get from National Oil Spill Detection and Response Agency (NOSDRA) show say di value of gas wey dem flare for dis period reach $2.2 billion, and di companies wey break di law—including International Oil Companies (IOCs) and National Oil Companies (NOCs)—supposed to pay penalties wey reach $1.2 billion.

NOSDRA talk say companies wey dey operate onshore flare 380.6 million standard cubic feet (SCF) of gas, while di ones wey dey offshore flare 243.8 million SCF. Di agency add say di flared gas produce about 33.2 million tonnes of carbon dioxide (CO₂) wey dey spoil di environment.

Di agency still cry say even with many years of intervention, gas flaring still dey happen for Nigeria, wey dey waste valuable energy resources and release harmful gases wey dey damage di atmosphere.

Dis one agree with World Bank’s Global Gas Flaring Tracker Report, wey rank Nigeria as one of di top nine countries wey dey flare gas for 2025, together with Russia, Iran, Iraq, Venezuela, Mexico, Libya, Algeria, and United States.

According to di report, “dis nine countries account for 83 percent of all gas wey dem flare worldwide for 2025, even though dem only produce 46 percent of global oil.” E add say global gas flaring rise go 167 billion cubic metres (bcm) for 2025, while Nigeria flare about nine bcm, wey make am di seventh-largest gas-flaring country for di whole world.