Nigeria, Jordan, Algeria and more than 20 other kontris don kick against Israel decision to recognize Somaliland as independent kontri. Dem warn say dat kain move dey break international law and dey threaten peace and security for Horn of Africa area.
Israel for Friday become di first kontri to officially recognize Somaliland, wey dem declare since 1991 after civil war wen dem break away from Somalia, but no UN member kontri don ever recognize am.
Nigeria issue dia own separate statement to comot mouth for Israel decision. Dem also sign joint statement with di over 20 kontris.
For statement on Saturday, Nigeria talk say dem dey "fully" support di sovereignty, unity and territorial integrity of Somalia.
Kimiebi Ebienfa, wey be spokesperson for Nigeria Ministry of Foreign Affairs write, "Government of di Federal Republic of Nigeria come again confirm say e no dey shake for di matter of sovereignty, territorial integrity and political independence of all UN and African Union member kontris."
Nigeria add say dem recognize Somalia government as "di correct authority wey represent Somali pipo" and condemn any action wey dey try to spoil Somalia constitutional arrangement.
"Nigeria Government beg all international players to stop dey recognize any part of Somalia territory as separate entity, because dat kain tin go just make di crisis worse," di statement talk.
Many kontris like United States, Saudi Arabia and Qatar also reject Israel decision to recognize Somaliland. African Union sef condemn Israel action.
POLITICS
2 minit wey yu go read
Nigeria join oda kontris to condemn Israel afta dem recognise Somaliland
Israel for Friday become di first kontri to officially recognize Somaliland, wey declare dia state since 1991.
Explore












