‘Dem dey escort Nigerians wey wan leave Iran reach Armenian border’
NIDCOM tok say dem dey do dis coordination of safe passage with di help of Armenian authorities.
Di Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM) don yarn say di Nigerian Embassy for Tehran dey safely escort di Nigerians wey wan leave Iran go di Armenia border.
For statement wey dem post for X, NIDCOM talk say di move na to "make sure say di ones wey wan leave di country get smooth and safe passage."
"Up till now, no Nigerian for Iran don suffer for di wahala, and government officials still dey dia for border to receive and help all di evacuees," di statement yarn.
"Di Federal Government dey very awake and dey respond well to ensure di safety and well-being of Nigerians all over di world."
NIDCOM tok say dem dey do dis coordination of safe passage with di help of Armenian authorities. Di commission yarn say government officials still dey station for border to receive and help all di people wey dem evacuate.
Meanwhile, dem don see at least one Nigerian among di 122 pipo wey injure for UAE, wen di Iranian ballistic missiles bin intercept for dia.