Policemen scatter Lagos anti-demolition protesters
For different places, di protesters demand say government show dem better plan if dem wan destroy dia house.
Human rights groups, activists and social media users don land for Lagos State Police Command and Lagos State Government for how dem carry police catch residents wey dey protest after dem don tear down dia house for different parts of Lagos for Wednesday.
Dis kain condemnation come afta police throw teargas to scatter hundreds of protesters wey gather for Ikeja to protest say government don drive dem comot for dia house without better compensation or place to stay.
Di protesters, wey come from Makoko, Oworonshoki, Owode-Onirin, Oko Baba and some oda areas, carry placards wey write: “Dem no fit build big city for di blood and bones of poor people,” “To be poor for city no be crime,” “Make una stop to kill us,” “Justice for Owode-Onirin traders,” and “Lagos no be only for rich people.” Dem still sing solidarity songs.
Di protest start for morning and plenty people join as dem reach Ikeja Under Bridge, where di protesters gather before dem march go Lagos State House of Assembly for Alausa.
For different places, di protesters demand say government show dem better plan if dem wan destroy dia house, plus compensation for pipo wey die for previous demolition.