President Tinubu go swear in Disu as Inspector General of Police for Wednesday
Nasarawa State Governor, Abdullahi Sule, still praise di President for im choice, e talk say Disu appointment na based on im excellent record for service.
President Bola Tinubu of Nigeria go swear in Olatunji Disu as di new Inspector General of Police on Wednesday, after di Nigeria Police Council okay im appointment on Monday.
"Di swearing-in go happen during di Federal Executive Council meeting wey dem schedule for di same day," Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, announce for statement on Monday.
Di council meeting wey dem hold for State House for Abuja, President Tinubu chair am, and Vice President Kashim Shettima, state governors, and Chairman of Police Service Commission, retired DIG Hashimu Argungu, all dey present, just as di constitution talk.
Diar others wey attend na Secretary to di Government of di Federation, George Akume; National Security Adviser, Nuhu Ribadu; Chief of Staff, Femi Gbajabiamila; Minister of Police Affairs, Ibrahim Gaidam; Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike; and Head of Service, Mrs Esther Walson-Jack.
According to Onanuga, Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, yarn well well about Disu, e praise am for im good work, especially di time wey e serve as Commander of Rapid Response Squad for Lagos between 2015 and 2021, where pipo sabi am for how e dey fight crime well.
Nasarawa State Governor, Abdullahi Sule, still praise di President for im choice, e talk say Disu appointment na based on im excellent record for service.