Nigeria Medical Council suspend hospital director, two doctors for Chimamanda pikin death
Nkanu Adichie-Esege, wey be one of Adichie twin pikin, die on January 7, 2026, for Euracare hospital for Lagos.
Di Medical and Dental Council of Nigeria (MDCN) investigation panel don suspend Euracare medical director and two oda doctors becos of Chimamanda Adichie pikin death.
Nkanu Adichie-Esege, wey be one of Adichie twin pikin, die on January 7, 2026, afta wahala show during some medical preparation wey dem do for am.
Afta di tin happen, Adichie send legal notice to di hospital, dey accuse dem say medical negligence and professional misconduct cause her pikin death. Di panel come set up make dem investigate di mata.
Afta dem do dia investigation, dem find say Euracare and Atlantis Hospital get case to answer for di way dem handle Nkanu sickness.
Because of dis, dem suspend Tunde Majekodunmi (Euracare medical director), Titus Ogundare (di anaesthesiologist), and Atinuke Uwajeg (Atlantis chief medical officer). Dem ban dis three doctors from dey practice medicine for Nigeria until di Medical and Dental Practitioners Disciplinary Tribunal finish dia own case.