Nigerian goment don collect 100 school children wey dem kidnap- Report
Bandits bin attack St. Mary's Catholic School for Papiri town wey dey Niger State on 21st November, dem kidnap 315 pesin - 303 students and 12 teachers.
Nigerian goment don take back 100 students wey dem kidnap from St. Mary’s Private Catholic Primary and Secondary School wey dey Papiri village, Agwara LGA for Niger State.
Na Nigeria media dem report am, dem quote security sources and authorities wey confirm say dem release the students on Sunday.
On 21 November 2025, gunmen wey dey ride motorbikes attack St. Mary’s Catholic School and carry away 315 people — 303 students and 12 teachers.
Security men and local trackers don scatter enter the forest for the area, dem dey search for the people wey dem carry.
Later, school authorities talk say at least 50 students run comot from the kidnappers and return to their parents.
That one mean say 265 people still dey the hand of the forest kidnappers — 253 students plus all the 12 teachers.
The matter alarm the goment and people for the country, and make some northern governors, including the one for Niger State, order make some schools close so dem no go kidnap more students.