| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
President Tinubu promise to support family of 11 security pipo wey bandits kill
Na Vice President Kashim Shettima carry di message on Tuesday, wen dem go Government House for Birnin Kebbi.
President Tinubu promise to support family of 11 security pipo wey bandits kill
Di security pipo lose dia lives to defend dia pipo / Reuters
3 hours ago

President Tinubu of Nigeria promise say e go support di families of di 11 security pipo wey bandits kill for Shanga Local Government Area for Kebbi State.

Na Vice President Kashim Shettima carry di message on Tuesday, wen dem go Government House for Birnin Kebbi.

E also sympathize wit Kebbi State government and pipo over di killing and di death of di Speaker of di state House of Assembly, Muhammad Usman-Zuru.

Tinubu call di two tragedies as “something wey heavy and painfull well well.”

Wen e condemn di attack, Tinubu say di killing of di security pipo na “barbaric act,” but e still praise dem courage and sacrifice for line of duty.

“We hail una for wetin una do. Di Federal Government dey do everytin wey possible to support una for all sides.

“We come here to show our deep sympathy to di families of di soldiers wey die and di communities wey di matter affect.

“We also come to grieve wit una over di death of di Speaker, Kebbi State House of Assembly, Rt Hon. Muhammad Usman-Zuru,” e talk.

Wen di governor reply, e say di President visit show say dem stand wit di state for dis time of sorrow.

“Dis visit clearly show your compassion and how una share di pain wit di pipo of Kebbi State. We really thank una,” di governor talk.

Idris reveal say di security pipo wey die bin fall into ambush as dem dey answer distress call for Shanga LGA, wey show di danger wey frontline operatives dey face.

E also talk say di late speaker bin fly go abroad for treatment but still die despite all di efforts.

“We try everytin wey we fit to make sure e get good medical care, but we submit to di will of Almighty Allah,” e add.

Di Emir of Zuru, Alhaji Sanusi Mika’ilu, wey also talk, praise di state government for supporting victims’ families and affected communities.

Di visit come as pipo dey worry again about insecurity for some parts of Kebbi State, as authorities promise to try more to stop banditry and bring back peace.