| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
2027 battle: President Tinubu don fire shots for opposition heavyweights
President Tinubu challenge critics and political opponents, as e declare say na im be di legitimate successor to former President Buhari.
2027 battle: President Tinubu don fire shots for opposition heavyweights
President of Nigeria Bola Tinubu / Reuters
17 Eprel 2026

President Bola Tinubu of Nigeria, on Thursday, talk say no amount of pressure or intimidation go fit make am comot from di work wey im suppose do.

E talk dis one as e reaffirm im administration commitment to di reform agenda, wey e say don already dey produce results for Nigerians.

E talk dis one for State House, Abuja, during meeting with di leaders and coordinators of Renewed Hope Ambassadors, one political mobilisation network wey dem inaugurate weeks before to take di government message reach grassroots.

Those wey dey di meeting include Vice President Kashim Shettima, Kaduna State Governor Uba Sani, Imo State Governor Hope Uzodimma, APC National Chairman Prof Nentawe Yilwatda and APC National Secretary Ajibola Basiru, plus odas.

Tinubu challenge critics and political opponents, as e declare say na im be di legitimate successor to former President Buhari.

E talk, "Dem want scare me? Na lie. I don pass through dis road before, and if I need to come back again and again and again, I go do di same thing.

"Nobody get better place pass your own country, and nobody fit build am except you.
"During di primaries wey bring me here, e tough. During di election, e tough. Now wey I don reach here, di only tin I fit promise be say I no go give up."

E tell di ambassadors wey come from all di geopolitical zones of di country say e don make dem promise wey e intend to keep.