| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Nigeria president order rescue afta dem kidnap plenty pipo for Niger
Tinubu direct security chiefs to give regular updates about di efforts to rescue di kidnapped pipo and account for all of dem.
Nigeria president order rescue afta dem kidnap plenty pipo for Niger
Tinubu say make dem give am updates

Nigerian President Bola Tinubu order di military and oda security agencies on Tuesday to start rescue operation immediately afta gunmen kidnap plenty pipo for north-central Niger State last week.

One armed group post video for Facebook and WhatsApp wey show wetin residents say be about 600 women, pikin and old pipo wey dem kidnap during attack for one mosque for di state.

Reuters no fit confam di number on their own, but if e true, e go be one of di biggest and most brazen mass kidnapping for Nigeria for recent years.

Di incident show sey Nigeria no fit protect many parts of di country wey different armed groups dey operate. Any effort to rescue di hostages go hard becos di gunmen know di remote border areas well well and fit hide for inside thick bush.

One official from Borgu district, wey di attack happen, say 30 pipo die during di attack and dem bury dem on Sunday.

Di official, wey no want make dem mention her name becos she no get permission to talk to media, say villagers from Dakera, Gidan-Zana and Sabon Gida communities dey affected.

For di first public comment about di incident, di presidency condemn di attack as cowardly and vow sey dem go bring those wey do am to justice.

"Terror no go scare Nigeria. We go defend our pipo, protect our communities and uphold di value of human life," Tinubu tok for one statement.

Tinubu direct security chiefs to give regular updates about di efforts to rescue di kidnapped pipo and account for all of dem.

Abubakar Umar, di traditional head of Dakera community, say at least 2,000 pipo run go neighbouring Benin Republic afta di attack.

Northwest Nigeria don dey be transit zone for guns and gunmen wey dey move around West Africa, but di area dey increasingly become place wey militants wey dey follow al Qaeda and Islamic State based for Nigeria or nearby Niger and Benin dey attack.

Kabir Adamu, one Abuja-based security expert, say e no dey possible to know who dey responsible but e expect sey di gunmen wey release di video go soon reach out to demand ransom.