Nigeria Presido and wife dey begin historic UK state visit
Di Presidency talk say di visit na to make di strong friendship between Nigeria and UK beta pass before.
pPresident Bola Ahmed Tinubu and im wife, First Lady Oluremi Tinubu go comot Abuja today go United Kingdom for two-day State Visit. King Charles III and Queen Camilla personally invite dem.
This one na big historic visit — na di first time for many-many years wey Nigeria leader go do State Visit for UK. And even beta pass, Tinubu go be di first Nigerian President wey British monarch go welcome for Windsor Castle.
Di Presidency talk say di visit na to make di strong friendship between Nigeria and UK beta pass. As we all know, Nigeria get im independence from Britain on October 1, 1960.
Di visit go open new ways for dem to work together for important matters like immigration, trade, investment and cultural exchange.
Di two countries dey do plenty business — di trade between dem don reach £8.1 billion (wey be $11 billion) as for September 2025.
Wit di big economic changes wey President Tinubu bring, plenty pipo for outside don dey see Nigeria with better eye.
As dem schedule di visit, Queen Camilla go host di Nigerian President and im wife for Windsor Castle tomorrow.