Di Inspector General of Police, Olatunji Disu, tok say di anti-crime operations wey dem do across di whole country from June 9 to June 21, 2026, make dem arrest 1,198 suspects for different states.
Wen e dey speak for monthly conference wit senior police officers for Abuja, di IG yarn say di arrests cover plenty offences, plus dem recover plenty illegal guns and stolen vehicles, and dem also rescue people wey kidnappers carry.
E tok say, “Since 9th June 2026, di anti-crime operations across Nigeria don lead to arrest of 1,198 suspects for different offences. Di numbers break down like dis: 151 suspects for murder and manslaughter, 117 for armed robbery, 151 for kidnapping, and 104 wey be cult members. Anoda 169 persons dem arrest for carrying guns without license.”
Di police boss still reveal say dem rescue 166 kidnap victims, and dem recover plenty heavy weapons and properties.
“Our operations still make us rescue 166 kidnap victims. We recover 166 different guns and 1,475 rounds of bullets of different sizes, plus 47 stolen vehicles,” Disu talk.
E add say behind every success na police officers wey do dia work well, even wen e dey dangerous for dem.
Talking about recent achievements, Disu call out di successful rescue of students and teachers wey kidnappers carry for Oyo State as example of good joint security operation.
“Di successful rescue of di students and teachers wey dem kidnap for Oyo State deserve special mention. Na clear example of wetin we fit achieve when Nigeria security agencies work together with one mind. Di operation succeed because of tight collaboration between Nigeria Police Force, Armed Forces, oda security and intelligence agencies, and members of public wey bring useful and correct information on time,” e tok.
Disu praise di operatives wey take part, saying “careful planning, honest inter-agency cooperation and good intelligence work” make di victims come back safe and sound.
POLITICS
2 minit wey yu go read
Nigeria police arrest 1,198 suspects, rescue 166 kidnap victims inside one month
Wen e dey speak for monthly conference wit senior police officers for Abuja, di IG yarn say di arrests cover plenty offences.

Explore





















