FIFA sanction Nigeria and DR Congo over wetin happen for World Cup play-off
FIFA tok say dem penalize Nigeria bikos of order and security mata for di match, especially di way fans dey throw sometin for ground.
Four months afta di 2026 FIFA World Cup African play-off final match between Nigeria and DR Congo wey get wahala, FIFA don sanction di Nigeria Football Federation and di DR Congo Football Federation bikos of wetin happen for di match.
DR Congo bin beat Nigeria for Morocco wit 4–3 penalty kick, wey make dem go intercontinental play-offs.
According to FIFA dia disciplinary report wey dem release for World Cup qualifiers, both di NFF and di Congolese FA dem guilty of different offenses for di match wey happun on November 16, 2025.
FIFA tok say dem penalize Nigeria bikos of order and security mata for di match, especially di way fans dey throw sometin for ground under Article 17 and Article 17.2.b of di FIFA Disciplinary Code. Bikos of dis, dem fine di NFF 1,000 Swiss francs.
For di side of DR Congo federation, dem carry heavier punishment bikos dia supporters use laser pointers or similar electronic devices during di match. Dis one break Article 17.2.d of di FIFA Disciplinary Code, so FIFA fine di Congolese body 5,000 Swiss francs.
Super Eagles coach Eric Chelle also bin accuse DR Congo officials of using voodoo afta di defeat.
Meanwhile, dis sanctions don make pipo dey expect di final verdict from di world football governing body more, especially on di NFF protest wey dem lodge against DR Congo for using players wey no qualify for di African play-off, particularly for di final match.
Nigeria bin complain afta dem lose di African play-off, dey argue say di Congolese federation mislead FIFA wen dem dey arrange nationality switch for some players wey born for abroad.