| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Iran Wahala: Nigerian government say price of tins fit still dey go up
Di government add say dem go still dey monitor di matter well-well, and dem go adjust policy wia necessary, so dat e no too spoil market.
Iran Wahala: Nigerian government say price of tins fit still dey go up
Nigerians dey complain say prices dey rise for market / AP
9 hours ago

Nigeria government don warn say di wahala wey dey hot for Middle East fit bring new shock go Nigeria, through rising energy prices, capital flows, and global supply chains.

Di government add say dem go still dey monitor di matter well-well, and dem go adjust policy wia necessary, so dat e no too spoil market, make investor still believe for di country, and protect Nigerian pipo well-being.

For statement by di Assistant Director of Information and Public Relations for Federal Ministry of Finance, Uloma Amadi, di ministry talk say di Economic Management Team (EMT) don begin to check di wahala wey dis crisis fit cause for economy.

According to di ministry, di EMT, wey di Minister of Finance and Coordinating Minister of Economy, Wale Edun dey lead, meet recently to check di wahala wey di crisis wey dey involve United States, Israel, and Iran fit cause.

Di minister still hold Naira-for-Crude policy coordination meeting, wia dem talk about wetin dey happen for global energy market and how e go affect us for inside.

Di officials identify three main channels wey di crisis fit use affect Nigeria economy.

Di first one na di wahala wey dey global crude oil and gas market. Dem talk say as energy price dey rise, e go make cost of petrol and oda energy materials for inside go up.

Di second channel na about financial market and capital flows. Dis one mean say as geopolitical risk dey high, investors go run go hide dia money for safer assets. Dis one fit make di money wey dey come for Nigeria reduce.

Di third one na about global logistics and supply chain. If di crisis spoil di major shipping routes or energy corridors, e go make freight cost high, and put more pressure on prices for inside.