IMF tok say Nigeria go overtake Algeria as Africa third biggest economy for 2026
For di moment South Africa dey carry number one with GDP of $426 billion, Egypt follow with $349 billion, then Algeria third with $288 billion.
For 2025, Nigeria be number four biggest economy for Africa, but according to IMF data, dem go climb reach number three position for 2026. IMF World Economic Outlook (October 2025 edition) show say Nigeria GDP for 2025 dey around $285 billion, wey make am dey behind South Africa, Egypt and Algeria.
South Africa carry number one with GDP of $426 billion, Egypt follow with $349 billion, then Algeria third with $288 billion.
But IMF predict say di West African nation go overtake Algeria for 2026 because economy go dey bounce back. Wetin go cause am na because oil production go increase, forex liquidity go better, and all de ongoing economic reforms go show results.
IMF projections talk say dia GDP go rise reach $334 billion, while Algeria own go be $284 billion. So Naija go become Africa third-largest economy, just dey behind South Africa ($443 billion) and Egypt ($399 billion).
IMF dey believe say all de recent reforms wey government do like petrol subsidy removal, exchange-rate liberalisation and fiscal adjustments go support growth for medium term, even though inflation still dey worry us for short term.