11 Februwari 2026
Finance Minister Wale Edun talk say from 2026, Nigeria government go begin sell government properties to private investors.
Edun yarn dis one for Saudi Arabia, for one conference wey dem organize for emerging markets.
E tok say dem still dey check which property dem wan sell and when exactly dem go sell am.
"Di plan na to start to sell some property for 2026," e talk.
Im still add say di things wey government don put on ground don make Nigeria economy sweet for investors, and dem don dey ready to bring money come now.
"Dem dey find private people wey go join government invest for government property," E talk.












