Nigeria suffer AFCON heartbreak after Morocco win to reach final

Nigeria goment for statement still hail dia team for dia ogbonge performance despite di loss as information minister Mohammed Idris say dem show fighting spirit for di match.

By
Chukwueze na one of two Nigerian players wey miss penalty. Photo- Reuters / Le point

Many Nigerians no enjoy dia Wednesday night after dia favourite team Super Eagles lose 4-2 on penalties to Morocco for di 2025 AFCON wey dey happun for north Africa.

Di match bin end 0-0 after extra time wey take di game to penalties before two Eagles players Samuel Chukwueze and Bruno Onyemachi miss dia spot kicks to give Morocco di win.

Nigeria goment for statement still hail dia team for dia ogbonge performance despite di loss as information minister Mohammed Idris say dem show fighting spirit for di match.

Billionaire Abdulsamad Rabiu say e go still give di Nigerian players di $500,000 wey e promise dem if dem win di match despite losing.

Nigeria go play di oda AFCON semi final losers Egypt for third place medal on Saturday.